Wetin we call dis foto, Elon Musk (left) wit Donald Trump outside di White House (file photo)
Article information
- Author, Lily Jamali
- Role, North America Technology Correspondent
Di boss of Tesla – Elon Musk tok say im go reduce im role for Donald Trump im administration afta di company profits fall during di first three months of di year.
Sales reduce wia di electric car maker don face kasala as Musk bin chop post for di White House.
On Tuesday, di company report 20% drop for dia first quarter of 2025, if una compare wit di same period last year; na so di profit also drop more dan 70%.
Di company don warn investors say di pain go kontinu, as dem refuse to tok if tins go beta as “to change political sentiment” go worry di demand for dia cars.
Di company don dey suffer as pipo begin to chook mouth afta Musk enta Trump im administration; im tok say di appointment bin shift im focus from di company.
Musk bin contribute more than one quarter of a billion dollars during Trump im ere-election campaign.
Im also dey lead Trump im department of goment efficiency (Doge) initiative to reduce federal spending and to slash goment workforce.
Musk tok say im “go reduce di time im dey spend for di Doge project next month.”
Im tok say im go spend only one to two days every week on goment matters “as long as di president go allow.”
Di way Musk dey involve for politics don vex many pipo wia im cause protests; na so pipo boycott Tesla around di world.
Im blame di kasala on di way some pipo bin dey try to “attack me and di Doge team”, but dis work dey “critical”.
According to di fresh figures, di moni dem make from Tesla for di quarter na $19.3bn (£14.5bn); dis don reduce by 9%.
Dis na less dan di $21.1bn wey sabi pipo bin dey expect, na so di company begin to dey reduce prices to attract buyers.
Di new tariffs wey Trump bin dey introduce for China also bin affect Tesla, sake of some parts of di cars wia dem dey sell for di home market, comot China, even tho na US dem assemble dem for.
“Trade policy wia don dey change quick quick” fit to affect di supply chain wia go increase di cost, according to di company.
“Dis development togeda wit di politics fit to affect how pipo dey buy our cars for future”, Tesla tok for dia quarterly update.
Musk don clash wit some of ogbonge pipo for di Trump goment – e don include di trade advisor Peter Navarro.
Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Musk im company wahala don begin afta pipo begin to chook mouth for di fact say im get ogbonge post for di Trump goment.
Early dis month, Musk bin call Navarro “moron” afta im make some comment about Tesla.
Navarro don tok say Musk “neva be car manufacturer” but im be “car assembler”.
Georg Ell, wey sabi Musk well well wey also be oga for Western Europe for Tesla, tok di BBC Today programme say if di multi-billionaire begin to dey “focus on di companies wia im sabi well well, I tink pipo go focus once again for di quality of di product and experiences.”
“I tink Elon no be pesin wey don surround imserf wit pipo wey gat different opinion to challenge di way im dey tink, oga Ell wia now be chief executive for translation software company – Phrase don add.
Musk tok on Tuesday say im tink say Tesla na car company wia di tariffs no affect plenty sake of im get supply chains for north America, Europe and China, but im add say di tariff “still dey tough on di company as di profits don dey low.”
“I go kontinu to ask say make dem reduce di tariffs, dat be wetin I fit do,” im tok on Tuesday.
Tesla also tok say artificial intelligence (AI) go fit help to grow di business for di future, even tho investors neva dey convinced by dis argument.
Di company shares don reduce about 37% of dia value dis year by di time di market don close on Tuesday, wia dem rise by more than 5% after-hours trading afta di results.
One sabi pesin Dan Coatsworth wey im be investment analyst for AJ Bell, tok say im expectations dey low afta di company tok dis month say di number of cars dem don sell for di quarter don fall to 13%, wia be dia lowest for di last three years.
Di company now dey face ogbonge competition, na so oga Dan Coatsworth warn say di global supply chain wahala afta Trump im trade war, fit “cause Tesla im problems to become worse.”